Andrew Cuomo: US President Joe Biden say make New York govnor resign

Wia dis foto come from, Brook Christopher
President Joe Biden don join call for Andrew Cuomo, New York govnor to resign afta investigation reveal say im don harass several women.
Oga Biden reaction come afta di State Attorney General Letitia James say Cuomo said violate state and federal laws wit im action.
Di investigation into New York Governor Andrew Cuomo find out say e sexually harass several women, including employees for im office.
Di report na di result of one month-long inquiry wey see investigators speak to nearly 200 pipo, including some of those way make complaints against di governor.
"Di independent investigation don conclude say Governor Andrew Cuomo sexually harass multiple women and in doing so violate federal and state law," Ms James tok.
Last year Oga Cuomo bin dey face accuse of sexual misconduct by several women.
"I think he should resign. I understand say di State legislature fit decide to impeach.
"I no know dat one for a fact. I never read all di data," US President Joe Biden tell tori pipo for White House.
End of Di one wey oda users dey read well well
Di New York govnor don deny say im touch any body anyhow and vow say im no go resign.
Wetin di Investigate for Andrew Cuomo reveal?

Wia dis foto come from, Reuters
One investigation into New York Governor Andrew Cuomo don find out say e sexually harass several women, including employees for im office.
New York Attorney General Letitia James wey announce di result of di inquiry say Mr Cuomo violate state and federal laws.
Last year Oga Cuomo bin dey face accuse of sexual misconduct by several women.
Im deny say e touch anyone inappropriately and reject calls from fellow Democrats to stand down.
Di report na di result of one month-long inquiry wey see investigators speak to nearly 200 pipo, including some of those way make complaints against di governor.
"Di independent investigation don conclud say Governor Andrew Cuomo sexually harass multiple women and in doing so violate federal and state law," Ms James tok.
Oga Cuomo, she tok, bin engage in "unwelcome and non-consensual touching and make numerous offensive comments".
Cuomo 'run finger down state trooper neck'

Wia dis foto come from, Getty Images
For one case, Cuomo and e staff retaliate against one former employee wey accuse am of wrongdoing, according to Ms James.
Other women describe say e grab, kiss dem or dem sit on di governor lap.
Cuomo allegedly reach under di blouse of im assistant to touch her breast, while another aide tok say im ask her if she dey open to sex wit older man.
Di governor stand behind state trooper inside lift, come dey run e finger down her neck and tell her say "hey you", according to investigators.
On top of di allegations of harassment, Cuomo dey face accuse of presiding over "hostile and toxic work environment".
Joon Kim, wey co-led di investigation, say: "E turn out to be culture wia you no fit say no to di governor and if you upset am or e senior staff dem go write you off, cast you aside or worse."
For e statement, oga Cuomo tok say: "I want you to know directly from me say I no ever touch anyone inappropriately or make inappropriate sexual advances.
"I be 63 years old. I don live my entire adult life for public view. Dat no be who I be. And dat no be who I don ever be."
New York senators, Democrats Chuck Schumer and Kirsten Gillibrand use di release of di investigation to again call for am to resign.
"Today report from di New York State attorney general follow di allegations of brave women wey come forward to share dia stories - and we commend di women say dem do so," dem tok.
Di investigation dey civil, rather than criminal, so e no go directly lead to charges. But police fit use di report to decide to take further action and e dey also likely to play key part for separate impeachment investigation im dey face.




















