Who be victims of deadly Florida jet crash?

Wia dis foto come from, Anthony Robinson/Facebook
Investigators believe say di parts of one private jet wey crash for Florida and kill all di nine pipo on board fit don break wen e dey for di air.
Di Learjet 60 wey dey go Bahamas from Austin, Texas wen e nosedive into one multi-lane highway and e explode on impact.
One tech entrepreneur and im young family, plus di 20-year-old copilot, dey among dos wey die for di Sunday crash.
Hia na wetin we know so far about di victims.
Adam Robinson and Helen Sharp
Di Texas tech entrepreneur, im wife Helen Sharp and dia two children, Emma, 4, and Charlie, 2, die for di plane crash, according to one joint statement from some of di families of dos wey kpai.
Dia family describe dem as "devoted parents" and dem tok say dia children be "di light of dia lives".
"Helen and Adam be di love affair wey go last forever. Dia warmth, generosity and gift for making pipo feel welcome bin touch so many lives," di statement read.
On im LinkedIn page, Robinson describe imsef as di founder and CEO of RB2B and Retention.com, plus di CEO of Moltsets.
End of Di one wey oda users dey read well well
Bifor dat, e bin work for global financial services business Lehman Brothers and di banking group Barclays.
Di BBC don contact di companies for statement.
Fellow tech entrepreneur, Jesse Ouellette wey write about Robinson death for one post on post tok say Robinson help am wen e dey build im company.
"E bicom my friend and pesin wey I see eye to eye wit on how to build software companies," Ouellette write.
"E fit disagree wit you about almost anyting, and somehow you go still leave liking am even more."
Robinson last post for di networking site na on Sunday, about one debate wey im and Ouellette schedule for di following week.
Meanwhile, according to media reports, Helen Sharp na artist.
Im papa, Dudley Sharp, tell Florida news site The Palm Beach Post say di news say im family dey onboard di plane na "quite a blow".
"We get one daughter, im husband and two grandchildren for di plane," e tok.
Rachel Reed, Charmi Fehr and Anita Maria Cetina
Reed, Fehr and Cetina also dey travel aboard di jet wit Robinson, Sharp and dia children.
For di joint family statement, dem describe Reed and Fehr as pipo wey "full of joy and adventure".
"Dem love dia pipo, fully and witout hesitation. From di moment dem meet, dem put evritin into each oda and di life wey dem dey build," di statement add.
E no immediately clear wetin dia relationship be wit Robinson and Sharp.
Di statement say Cetina "care for Emma and Charlie wit tenderness and devotion, and she truly be part of di family".
E add: "She show us one legacy of unconditional love and devotion."
Jeff Gregory
55-year-old Gregory na pilot of di jet, according to East Coast Jets, one private charter company wey identify Gregory as e don work wit dem bifor.
"We dey deeply sad to learn say Captain Jeff Gregory dey among dos wey lose dia lives for yesterday tragic aviation accident for Palm Beach," one tok-tok pesin for di company tok for statement on Monday.
Di tok-tok pesin say Jeff bin work for East Coast Jets "briefly" from 2016 and 2017.
Nathalia Filgueiras

Wia dis foto come from, Nathalia Filgueiras/Thread
US media don identify 20-year-old Nathalia Filgueiras as di copilot of di plane. She receive her pilot licence wen she be 17 years old.
Filgueiras mama, Camila Corteleti, confam to US media say her daughter die for di fireball.
Corteleti tell di New York Times: "She love di freedom. E dey completely different to see di world from di top."
For one 2023 interview wit one local news affiliate of CBS News, Filgueiras bin tok proudly about receiving her pilot licence wen she still be senior for high school.
"I like to dey different from evrione," she tok. "Some pipo tink say e dey weird say I fit fly planes, but I no fit drive motor, I mean I fit, but plenty pipo tink say e funny."
NTBS tok likely cause of crash
US National Transportation Safety Board (NTSB) tok say weather condition na one of di main things dem go investigate for di plane crash. But dem say e still hard for dem to reach di wreckage becos di jet create one very big crater for di road wen e crash for Palm Beach.
Di plane crash on Military Trail, one six-lane road wey feature businesses and restaurants, at around 12:50 local time.
"Di biggest challenge wey we go get na recovering di major wreckage from di impacted crater for di roadway," lead investigator Tim Monville tok for one news conference on Monday.
Officials dey try to find out weda one cockpit voice recorder bin dey on board at di time of di crash and if dem fit recover am.
Flight analysis show say di jet bin dey fall wit speed hundreds of feet per second bifor e crash.
For inside di air traffic control audio recordings, dem fit hear as pesin for di cockpit dey report "moderate turbulence" and e say di crew dey "manage di ice".
Dem fit hear di crew dey tok say di plane dey "pick up heavy rain and cloud (precipitation)" and say "we need to climb go higher."
Moments later, di same voice tok say di plane dey descend at a speed of about 10,000 feet evri minute.
Dem come declare emergency, and for di audio, dem fit hear di crew dey shout say, "We dey overspeed as di plane dey descend at 20,000 feet per minute." Shortly afta, dem add say, "We go crash for ground."






















