New UK immigration rules for legal migrants

Wia dis foto come from, EPA
- Author, Iain Watson
- Role, Political correspondent
- Author, Toby Mann
- Published
- Read am in 5 mins
United Kingdom Home Secretary, Shabana Mahmood don announce di new immigration rules wey UK govment don set for immigrants on Monday, 2 November
Di Home Secretary tok say migrant care workers wey dey earn at least £25,000 and wey enta UK bifor May 2025, go get indefinite leave to remain (ILR) afta five years.
Mahmood give di breakdown to some of di immigration rules wey UK don set inside di House of Commons on Monday.
She tok say dem go offer pipo wey dey social care sector wey neva fulfill di conditions of dia visa "second chance" to apply for anoda five-year visa, if dem arrive di UK bifor May 2025
Mahmood say migrants wey arrive di kontri as refugees "wit small boat" go wait for 20 years for settlement, if dem dey work or study.
But if dem no dey work or study and dem enta UK through small boat dem go need additional 10 years - 30 years for dia legal settlement, she add.
Mahmood tok say di five-year path to settlement go remain open for workers wey dey earn salary of more dan £50,000 per year and pipo wey dey make contributions in healthcare and education, as well as refugees wey enta di UK through safe and legal routes
She tok say pipo wey dey make "exceptional" contributions, like taxpayers for di highest band wey dey earn more dan £125,000, fit apply for settlement afta three years
End of Di one wey oda users dey read well well
As she dey announce di policy, Mahmood explain say pipo wey no come under di new exceptions go dey on 10-year path to settlement status, including pipo wey dey earn less dan £50,000
She also tok about di govment disqualifying criteria for settlement, wey include criminal record and inability to speak English well-well. Also, pipo wey breach immigration law, go push dia wait back to 20 years
Pipo wey land di kontri via small boat and dey work or study go wait for 20 years for settlement, wit anoda 10 years if dem neva work or study.
How di new rules go affect migrants?
Under di govment plan, di standard length of time migrants go need live for UK to qualify for permanent settlement go double from five to 10 years.
Under dis 10-year pathway, applicant must earn at least £12,571 for five out of di seven years bifor dem go grant dem settlement.
But, shorter qualifying period of five years dey for some groups, including:
- Pipo wey dey earn at least £50,271 for three out of five years bifor dem apply for settlement
- Care workers wey dey earn at least £25,000 per year while dem dey meet dia visa conditions and arrive for UK bifor May 2025
- "Skilled" public service workers, like doctors, nurses and teachers
- Oda health and education public service workers wey fall below dis skill level, for example nursing auxiliaries and teaching assistants, if dem arrive UK bifor May 2025
- Pipo from Hong Kong wey hold British National (Overseas) status
Pipo wey dey earn ova £125,141 per year, plus "highly skilled" migrants like migrants wey dey on Global Talent or Innovator Founder visas, go qualify afta three years.
Migrants wey don claim some benefits or breach immigration rules no go fit settle until afta 20 years.
To qualify for settlement, migrants go also need meet oda conditions like:
- No criminal record
- Speak English to high standard
- Dey pay tax regularly
- Earn at least £12,571 per year for at least three years, aligned as di threshold for paying income tax
Wetin be Indefinite Leave to Remain
Indefinite leave to remain (ILR), wey also dey known as settlement, dey give pesin di right to live, work and study for di UK for as long as dem like.
Dem also fit apply for benefits if dem dey eligible. Dem fit also use am to apply for British citizenship.
Mahmood bin announce plans to delay settlements in response to concerns on top di number of pipo wey go soon reach eligibility, for di wake of record post-Brexit net migration figures under di previous Conservative govment.
Di Home Office tok say dia figures show net migration - di difference between dos wey dey enta and leave di kontri - 2.6m pipo add to di UK population between 2021 and 2024.
Di department dey forecast say around 1.6m pipo fit therefore settle between 2026 and 2030.
Dem submit more dan 200,000 responses to di consultation on Mahmood proposals, wey dem launch under former Prime Minister Sir Keir Starmer.
Several Labour MPs bin raise concerns about di impact of di proposals on migrants wey already dey live there, as dem describe di retrospective approach as "un-British".
Dem also warn say e fit make UK skills shortage worse, especially for di care sector.
Mahmood bin argue say di reforms dey important to avoid a "drain on our public finances".
For her foreword to di consultation, Mahmood tok say di bar to enta di UK don "reduce well-well" and dis dey most evident for di health and care visa".
She write: "One attempt to fill between 6,000 and 40,000 jobs see di arrival of 616,000 individuals from 2022 to 2024.
"Ova half no even dey land di kontri to work for dat sector but instead na dia dependants dey do am."
Home Office calculations bin suggest say 196,000 care workers plus dia adult dependants fit settle between 2026 and 2030, for inside one estimated lifetime cost of £9.5bn to taxpayers.
On Monday, di Institute for Public Policy Research (IPPR) think tank tok say skilled workers and dia dependants due to settle for UK under current rules dey expected to make net lifetime contribution of around £115bn through di taxes dem dey pay.
Prime Minister Andy Burnham last week tok say settlement na "right to be earned, no be sometin dem dey give pipo automatically".
Di Home Office no go tok pim on Mahmood final decisions till dem carry am go meet parliament.
For September, Conservative tok-tok pesin say, "Shabana Mahmood don bend for pressure of Angela Rayner and ger open borders MPs and go tear her own plans to reform idefinite leave to remain".
Di pesin add say, "dis na slap to di face of British taxpayers wey go need subsidise low-skilled, low wafe migrants."
Permanent residence, or indefinite leave to remain, na wetin dey give pesin right ot live, work and study for di UK as long as dem want. Dem also fit apply ofr benefits wey dem qualify for.





















