Ican don win Nobel Peace Prize

Wia dis foto come from, Getty Images
Nobel Peace Prize don enter di hands of di International Campaign to Abolish Nuclear Weapons (ican).
Di Chairperson for di Nobel committee talk say dem give di group di award because of di "original effort wey dem use to get agreement for di ban" on top nuclear weapons.

Wia dis foto come from, Getty Images
For July, after ican bin give countries stress, 122 countries enter agreement with di United Nations say dem go ban and comot all nuclear weapons.

Wia dis foto come from, Reuters
Ms Reiss-Andersen talk say make di countries wey get nuclear power begin talk about how dem go slowly remove nuclear power.
Ican na di join bodi of hundreds of non-governmental organizations wey don dey work for ten years now. For December, dem go collect $1.1million, medal and diploma for one ceremony.
Economic Community of West African States (ECOWAS) bin dey one of di organizations wey dem consider to give di peace prize.















