Jesus de Miguel die afta head collision wit Jesus Owono for Spanish football game

Wia dis foto come from, CLUB DE TENERIFE/FACEBOOK
Tenerife striker Jesus de Miguel don die afta e suffer serious injury during one Spanish second-division match.
Di 30-year-old forward bin suffer head and chest injuries during one match against FC Andorra on Monday, 2 November forone heavy collision wit goalkeeper Jesus Owono during di game.
Owono receive red card immediately becos of di challenge.
Dem describe De Miguel condition as 'stable but serious' on Monday but im health bin grow worse on Tuesday morning.
Di Spaniard later die at 07:00 GMT. Tenerife confam di sad news wit one statement.
Under Spanish law, any death wey dem no see as natural dey automatically trigger judicial inquiry.
"Heartbroken, wit lump for our throats and we n fit believe say na true" Tenerife tok.
"We no get words of comfort; nothing dey to reduce dis big sadness. We stand wit im grieving family, wit im loved ones, wit all of Tenerife wey dey mourn dis cruel loss today."
End of Di one wey oda users dey read well well
'Words no dey'

Wia dis foto come from, TIKITAKA.RO/FACEBOOK
Tenerife and Andorra bin dey draw 2-2 seven minutes into stoppage time wen di incident occur.
Owono run towards di centre circle to clear one long ball wen e be like say im knee collide wit De Miguel.
Di striker bin lie motionless for di pitch as medical staff treat am bifor dem use ambulance carry am from Tenerife Estadio Heliodoro Rodriguez Lopez go hospital.
Players from both teams dey shocked by di incident, as some of De Miguel team-mates dey cry.
Di referee sama Owono red card straight bifor e comot di match.
Di goalkeeper, wey get ova 30,000 followers on Instagram, don deactivate im account as at Tuesday morning.
Spanish media, including Marca, report say De Miguel bin suffer cardiac arrest for di ambulance and paramedics revive am back on di way to hospital.
Tenerife president, Felipe Minambres, tok say di club players go need "professional assistance" to help deal wit di trauma to see one of dia team-mates dey die.
"All of us feel weak and deeply sad right now. E dey hard to even believe wetin don happun," Minambres tok.
"We know, especially say di players plus di players' partners, go need support. We don already dey receive offers of help today, and dat support go continue.
"We go need professional assistance, but we also need di support of all our fans, becos dem go dey feel di same way we dey feel today."
Minambres add say di "situation dey truly unbelievable" plus "na big tragedy dem gatz endure".

Wia dis foto come from, Reuters
Andorra, Tenerife opponents on Monday, say: "Wit broken hearts and devastated, we wan send our most sincere condolences to di family of Jesus de Miguel, to all im team-mates, friends, and to CD Tenerife."
Former Barcelona defender Gerard Pique, wey gada get di Andorra, say: "I dey sorry wit all my soul. Rest in peace, Jesus."
De Miguel former club, Castellon, say: "E dey hard to find words wen reality strikes for dis kain unfair way.
"We join wit all our affection as we grief wit im family and loved ones, whom we embrace for these terribly difficult moments and to whom we extend our most heartfelt condolences."
Javier Tebas, president of La Liga, say: "Today, all of us share di terrible pain of one irreparable loss.
"My deepest condolences to im family, loved ones, team-mates plus di whole club."
Uefa bin release message wia dem console di family of di Spanish player and im club.
"Di European football community dey mourn di death of Jesus de Miguel Alameda. We dey extend our deepest condolences to im family, friends and teammates."
Uefa add say "players and teams go observe moment of silence for all Uefa games dis week to honour di memory of di late 30-year-old."
Di Spanish football federation wey bin "dey saddened by di news", don announce say dem postpone di Spanish cup games wey dem suppose play on Tuesday sake of di tragedy.
Former Barcelona defender Gerard Pique, wey be co-owner for Andorra, tok say: "I dey sorry wit all my soul. Rest in peace, Jesus."
Top clubs wey include Barcelona, Real Madrid, Atletico Madrid, Manchester United, Marseille, Fenerbahce and odas don share dia tributes and condolences.
De Miguel im former club, Castellon, tok say: "Na hard to find words when reality strike for dis kain unfair way.
"We join wit all our affection for di grief of im family and loved ones, wey we extend our heartfelt condolences."
Javier Tebas, president of La Liga, add: "Today, we all dey share di terrible pain of dis ogbonge loss.
"My deepest condolences to im family, loved ones, team-mates and di whole club."
Real Madrid and France striker Kylian Mbappe write on im social media: "Much sadness, words no dey."
Inter Miami and former Barcelona forward Lionel Messi say: "Words no dey. My condolences and lots of strength to all im family and friends."
Di Spanish football federation announce afta De Miguel death say dem don postpone Tuesday Spanish Cup fixtures.
Dem suppose play two fixtures for di first round of di men's Copa del Rey, while Espanyol suppose take on AS Celtas for di women's Copa del Reina competition.
Lower-league player but wit eye for goal

Wia dis foto come from, Alamy
Dem born De Miguel for Madrid, and e start im career for Leganes for 2015. E later go on to play for eight different clubs for Spain.
Di 30-year-old bin play for Lugo Fuenlabrada and Internacional Madrid. E later return to Fuenlabrada bifor e play for Union Adarve, Navalcarnero and Unionistas.
Miguel later join Castellon for 2023 and e score 16 goals as di club gain promotion to di second division for Spain one year later.
Di Spaniard bin join Tenerife for one three-year deal for 2025. E score 11 goals for 29 games for dem bifor im death.
De Miguel leave behind im daughter, Carla de Miguel Fernandez, wey dem born for 2025.






















