Ronaldo 700 goals : Oda footballers wey score pass 700 goals for dia career

Cristiano Ronaldo
Wetin we call dis foto, Ronaldo's goal was his 95th for Portugal
Published

Cristiano Ronaldo number 700 goal for Portugal Euro 2020 qualifier football match for Ukraine add am for list of highest goal scorers.

Di 34-year-old score penarity as Portugal lose 2-1 to Ukraine.

Dis Ronaldo goal, mean say im don join oda ogbonge footballers wey don score at least 700 goals for dia football career.

According to data from Rec Sport Soccer Statistics Foundation, Di Juventus forward Ronaldo, still dey back back for di list as di footballer wey don score goal pass, na Czech-Austrian Josef Bican wey get 805 career goals

Gerd Muller, Ferenc Puskas, Pepe, Romario, Josef Bican
Wetin we call dis foto, Gerd Muller, Ferenc Puskas, Pele, Romario, Josef Bican be di only players wey don score pass to have scored more than Ronaldo

Next pesin for di list na Brazil legend Romario, wey get 772 goals, while im kontri man, Pele na number three for list wit 767 goals.

Hungary legend Ferenc Puskas get 746 goals for im record, while former Germany striker Gerd Muller di top five with 735 goals.

No be today Cristiano Ronaldo don dey break record. if you tok of any record for football im don break am.

Im get di 700 goals from 973 matches wey im don play and e don score at least once for 458 out of di football matches.

Di goal wey im score for Portugal for di Ukraine match also be di 95th wey im don score for Portugal.