Yemen war: Saudi air strike don kill 29 pikin inside bus

Wia dis foto come from, Reuters
Twenty nine pikin don die and 30 odas wound afta Saudi coalition use air strike bomb dia bus for Yemen.
Yemeni tribal elders tell tori pipo Associated Press say di pikin dem bin dey travel inside di bus go back school for Dahyan, wey dey northern province of di kontri.
But di health ministry, wey Houthi rebels dey control, say na 43 pipo die and 61 wound.
Houthi tok-tok pesin, Mohammed Abdul-Salam, accuse di coalition say dem no send human life as dem target public place wey pipo dey go.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
Di Saudi coalition say wetin dem do dey legitimate because dem no target civilians.
But human rights groups dey accuse dem say dem dey bomb markets, schools, hospitals and house wia pipo dey live.

Wia dis foto come from, Reuters
Charity organization, Save di Children, say di driver of di bus bin stop for market to buy drink wen bomb blow.
Dem say correct investigate suppose land on top dis kain bad tin.
End of Di one wey oda users dey read well well























