Royal baby name na Prince Louis

Wia dis foto come from, Getty Images
Di Duke and Duchess of Cambridge don name dia third pikin Louis Arthur Charles.
Di couple born dia second son on Monday for Lindo Wing of St Mary Hospital inside London and e weigh 8lb 7oz.
One tweet from Kensington Palace confam say dem go dey address di baby as His Royal Highness Prince Louis of Cambridge.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
Di new prince dey number five in line to di throne.

Wia dis foto come from, Getty Images
Louis na one of di middle names of Prince William and of di new prince brother, George.
Na also di first name of Lord Mountbatten - im great-great-uncle - wey IRA kill for 1979.
Arthur na also one of di duke middle names, and na also middle name of King George VI - di Queen papa


















