Mexico don confirm say people earthquake kill reach 90

Wia dis foto come from, AFP
Na at least 90 people don die for di 7 September earthquake for Mexico; officials na im confirm dis number, as rescue operations and funerals dey go on.
One government spokesman say na 71 people die inside di south-west state of Oaxaca alone.
Tori be say hundreds of families just dey hang around, dey sleep inside di streets, as dem dey fear whether aftershock fit still troway building on top dem head, if dem sleep inside house.
Di Mexican Seismological Service say after di main earthquake where everywhere shake, na 721 different aftershock dem don record so far.
Di earthquake na di strongest one wey di country don take eye see, since 100 years.
On Friday, na tropical storm Katia still hit Mexico east coast.
Two people die inside mudslides wey happen, after heavy rain fall.

Wia dis foto come from, Reuters

Wia dis foto come from, Reuters

Wia dis foto come from, EPA

Wia dis foto come from, AFP

Wia dis foto come from, AFP/getty

Wia dis foto come from, AFP/GETTY

Wia dis foto come from, AFP/GETTY

Wia dis foto come from, AFP/GETTY


















