Yemi Osinbajo helicopter crash: Di message wey Atiku, Fayose and odas send give vice president afta e survive

Helicopter for ground
Wetin we call dis foto, Di helicopter afta e crash land
Published
Read am in 2 mins

Nigeria opposition Peoples Democratic Party presidential candidate Atiku Abubakar don send message give Vice President Yemi Osinbajo afta im survive helicopter crash on Saturday, February 2.

Inside di message, Atiku tok say belle sweet am to hear say Osinbajo survive di crash.

"I just receive di news of your helicopter crash for Kabba, Kogi stae. I dey happy say notin do you and your delegation." Na wetin Atiku tok be dat.

Skip X post, 1
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 1

Inside im message, President of di senate Bukola Saraki also thank God for di VP life.

"I join all Nigerians to thank God for sparing di life of di Vice President Yemi Osinbajo who survive Helicopter crash for Kabba today." Na so Saraki tok.

Skip X post, 2
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 2

Leader of di House of Representatives Yakubu Dogara wey also send message to wish Osinbajo well ask say make authorities do dia work well so dis kain tin no go happun again.

"I join His Excellency to thank God for saving im and im team from di accident for Kogi State. I call on di relevant authorities dem to o due dilligence check ontop all goment aircraft dem so dis kain tin no go happun again." Na so Dogara tok.

Skip X post, 3
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 3

Former govnor of Ekiti state wey also no dey hide im own to crticize di ruling goment also send goodwill message give Osinbajo.

"I rejoice wit di VP Yemi Osinbajo and I thank God for keeping im alive today, I wish am quick recovery from any minor injury im go don sustain inside di crash,"

"For me, say pesin life dey kampe go beyonf politics and I pray say God go continue to dey protect am." Na so Fayose tok.

Skip X post, 4
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 4

Meanwhile inside statement wey di office of di Vice President release, im thank all Nigerians for dia message and concern say im and im team dey kampe and im dey carry go wit im Next Level engagement for Kogi State.

"We dey very grateful to God for preserving our lives from di incident wey hapun."

"Everyone dey safe and nobody injure, God don keep us, deliver us from death so we go fit do more for our pipo and kontri." Na so di Vice Presido tok.

Di company wey dey manage di helicopter Caverton say na bad weather cause di crash and dem don begin investigate how e take happun.