Afcon 2021 Qualifiers: Partey, Kudus goals give Ghana 2-0 victory over South Africa

Ghana Football fans
Published
Read am in 1 mins

Ghana start dema 2021 Africa Cup of Nations (AFCON) qualifying campaign in style as dem manage keep clean sheet in dema 2-0 win against South Africa.

De Blacks Stars of Ghana dominate dema Bafana Bafana counterparts throughout de game on Thursday for Cape Coast Stadium, Ghana where dem pick all three points.

Ghanaian international, Thomas Partey tear de net around de 32nd minute after assistance from Jordan Ayew.

Skip X post, 1
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 1

De second goal come from substitute, Kudus Mohammed who seal de victory for Ghana around de 83rd minute of de game.

For most Ghanaians, if Kwesi Appiah den en boys continue dey play well like dem do against South Africa, den dem go fit win back de heart of Ghanaian soccer fans.

Skip X post, 2
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 2

After poor performances den failure to win any cup in decades, current GFA President, Kurt Okraku initiate #BringBackTheLove campaign which dem want take pull support give de Black Stars.

Ghana currently dey second place for Group C behind Sudan, who finish Sao Tome and Principe 4-0 on Wednesday.

De Black Stars go face Sao Tome and Principe in dema next match which go happen in matchday of on November 18.